Temitope Balogun Joshua.

Wia dis foto come from, TB Joshua

Wetin we call dis foto,

Pastor TB Joshua die at di age if 57 on Saturday June 5, 2021

Di Synagogue, Church Of All Nations for Lagos, don announce when and where dem go bury dia founder di late Pastor Temitope Balogun Joshua.

For statement wey dem release on Monday, dem say dem go bury Prophet TB Joshua inside di church headquarters for Lagos.

“We dey currently prepare for one week-long service from Monday 5th to Sunday 11th July 2021 in honour of Prophet TB Joshua life and legacy.”

“We go bury am for The Synagogue, Church Of All Nations (SCOAN) for Lagos, Nigeria.” Di statement tok.

Di church announcement dey come afta Prophet TB Joshua widow Evelyn Joshua bin tok last week say dem go make public di burial arrangements when Lagos state goment pay her condolence visit.

Di church say Emmanuel TV go broadcast all di services live and di service go dey open to di public.

Who be Pastor TB Joshua?

Pastor TB Joshua die at di age if 57 on Saturday June 5, 2021 few days to im birthday. Im death shock pipo and cause reactions from im congregation and leaders from around di world.

Before im death, im be Nigerian pastor, televangelist and philanthropist wey popular through organizing “miracle,” “healing” and “deliverance” program.

TB Joshua found di Synagogue Church of All Nations for 1987 with just few members wey later grow to plenti members to even outside Nigeria.

Prophet TB Joshua dey popular across Africa and Latin America.

TB also dey controversial based on im teachings and practises. Some pipo bin dey criticise am, sake of di large amount of alleged miracles wey take place for im meetings.

For 2017, Chris Okotie, Pastor and popular televangelist for Nigeria, accuse Joshua of “shamanist practices.”

Christian critics often dey refer to TB Joshua unorthodox methods say e no dey confam for di Bible.

Asides from di controversies around im methods, some pipo also hail am for im humanitarian works.